Wednesday 26 August 2015

OGA POLICE NOBI SO DEM DEY ARREST PERSON O!









           Time done reach wey we for ajegunle go standout and yarn true talk on top our right, we no dey military rule so why one olopa go dey go against the right of one citizen for we community, he no dey right at all and we for VOA one make sure we yarn our mind finish on top this matter wey dey ground.
What if that person wey that police dey draw na him brother sey him go do like that? he no dey right at all, that citizen get him own right so maker them no dey tanish or go against am cos he no good at all.
We citizens also need to respect ourelf cos this them our police some times there head they turn anticlockwise way, but still we want them our top oga make them shook mouth for this matter and make we they sure say the part of constitution wey them write all citizens have the right to speech and freedom, they for us and no be say one olopa go come take over am.

No comments:

Post a Comment

Subscribe

Labels

Flickr