Wednesday 12 August 2015

FIGHT FOR BOUNDARY(ONE PERSON KILLED)

Report wey Come our table as at yesterday nite wey be 12 of august 2015, sey them fight no be small for boundary yesterday, though we for VOA try reach there to get full information, but wetin we here no good at all, one woman being yarn us say na normal mash me mash you, na him cause the casala wey make this whala sele. Now we here say them kill person wey da na man or woman we no even know as na dfferent thing everybody dey yarn..... We for VOA go still go back to the scene of the crime make we for ask some more people wetin really happen..... Now the question na where them the olopa(police) wey dey boundary tanda put wey this kind kasala come happen for we area abi make we no dey feel secured again and we dey claim say we get police?.... more information on top this matter dey come soon.... no forget to always tune in to your number #1 website and like our page at www.facebook.com/voiceofajcity stay tuned.......

No comments:

Post a Comment

Subscribe

Labels

Flickr