Friday 20 November 2015

ARE YOU A TEENAGE MOTHER THAT'S WANT TO GO BACK TO SCHOOL?



Every time na him we dey yarn say Education na the best legacy for the world currently, people like Prof, Wole Soyinka, Nelson Mandela, even for Nigerian music, Falz the badguy , Dr sid, Waje, and many others dey educated, but base on God given talent some people no dey like Go school, them prefer to start up their ideas all by themselves, and we for VOA like am because we want Ajegunle to dey filled with creative business entity, and Enterprenuers so that we go fit become the world largest economy. The question now be say:
 Sey education dey compulsory


Some people dey go school with the aim of graduating, and coming to work with their certificate, while some people dey go school because them hear and see other people dey go, some other set of people dey go school to get more knowledge about the world and him global/wide range economy so as to create their own business, and make profit in the aspect wey them choose to place their capital on top. Now back to my question,  sey education dey compulsory? With the small tori wey I don nack now, u suppose fit fined answer to that question as at now and try to make a move,.
Some people especially women fit think say bcos them done born them no fit go school again, so na to open shop dey sale pure water, indomie and food stuff na him remain for them but no be so, Them fit make am big if them decide to them fit turn that indomie shop to indomie factory that pure water hawking to pure water company and lot’s  more, but  how dem fit take do am?
We for VOA dey proud to tell una say an organization wey carry Ajegunle matter for head like bag of rice, done sit Lagos state Government down on top this same matter and base on say dem no give them breathing space Lagos state  done bring solution with immediate effect.
The name of this organization wey dey fight for pregnant girls and mama them wey done born pikin to go back to school na  AJEGUNLE GREATS ELITES ASSOCIATION. Dem dey very worried with the way small young girls dey drop out of school because of pregnancy and pickin wen dem born inside our community AJ CITY . Now them dey in touch with Lagos state government approved ALTERNATIVE GIRLS SECONDARY SCHOOL , and for dere u fit carry yor pickin dey go skool and u get opportunity to learn skills like HAIRDRESSING, TAILORING, CATERING, BEAD MAKING, MANUFACTURING  e.t.c  alongside your education. Voice of ajegunle and this association dey look forward to helping so many young girls when ready to become great and make we community proud.

No comments:

Post a Comment

Subscribe

Labels

Flickr