Tuesday 1 September 2015

See wetin blocked drainage cause for KOJO street, which kind yawa bi dis?

                People for ajegunle no dey like take precautions and this dey affect us badly, na since we done dey complain about the dirty wey people dey dump inside gutter, no be say lawma no dey show ooo but people no dey get patience. Dirty no be better thing that's why different kind of sickness dey affect us from maleria to typhoid and all this nyama nyama disease because of the way we dey keep things, he no dey right at all as even bible self talk am say cleaniness is next to Godlyness, but the dirtty palaba for AJ no be small story at all, and we really need to change.

                Since na him rain done dey give people for kojo warning note as them no dey agree to wetin peiople talk, now small rain wey fall no be say na flood for noah time done take over the whole area because of all this dirt wey them we people dey put inside drianage, no be the write thing but people no dey hear, now every where for kojo done flood like say sea overflow enter we city.
         
                Wetin we for VOA go like talk  on top this matter be say we need to change our attitude so that ajegunle wey be our city and nigeria's number one standard ghetto go dey safe for all of us.

               Please make una always dey login to the VOICEOFAJEGUNLE for more stories about wetin dey happen for ajegunle, and make una dey speak una mind for our comment box we go really appreciate am.







No comments:

Post a Comment

Subscribe

Labels

Flickr