Wednesday 3 June 2015

DEMOCRATIC SOCIALIST MOVEMENT(no light nopayment for ajcity)

AJEGUNLE PEOPLE HOLD MASS MEETING ON TOP THE POOR POWER SUPPLY AND ESTIMATED BILLS WEY DEY TROUBLE US.


A cross section of the residents - photo DSM
photo DSM by VOICEOFAJEGUNLE.
On Tuesday May 26, 2015 about 200 residents of Layinka Street, Arumoh Street, Jibowu Street, Sani Close, Kojo Lane, Amechi Street, Akali Lane, Etugbo Lane, Olatoye Close, Bara Street, etc come 2gether for Nawair-ud-deen Primary School, NUD, Primary Arumoh Ajegunle Apapa, Lagos for a mass meeting of all the whole community people for the poor power supply and the increase for dem nepa aj consumers with estimated billing by Eko electricity distribution company (EKEDC).

Daggar Tolar addressing the meeting - photo DSM

Dagga Tolar addressing the meeting - photo DSM
. Dagga Tolar, a member of DSM National Executive Committee, na him stand gidigbam on top dis matter wey. everybody both mama papa and pikin na him come 2geter on top dis matter and them put say na Thursday June 4, 2015, na him dem go take go do rally for Apapa office of EKEDC and many people dey support them wella you knoe say we for voice of ajegunle dey like make una dey inform so we go shook mouth and ear on top dis matter. Them say na 6050naira na him them spend on the going and coming levels and them being done do rally on may 30 to get plenty support on top dis matter. Just make sure you day tunein to your own VOICEOFAJEGUNLE for more tori on top this matter and plenty more tori.

No comments:

Post a Comment

Subscribe

Labels

Flickr